START UP / TO START
Support
If you need assistance or you wan contact the Ayoba people, abeg go Ayoba.me/contact
Download and Installation
How I go download Ayoba?
- Ayoba.me/download – (free data); or
You fit visit the Ayoba website go download the app at anytime, If you be MTN user you go fit download Ayoba for free, and you no go use your data.
- Google Play store
You fit download Ayoba from Google Play Store. E simple just open the Play Store, search Ayoba then download so you go begin use Ayoba.
How I go take update Ayoba?
Ayoba go fit update on top the Google Play store or
For now the Ayoba App only dey for Android phones dem (other models go soon come!). To update am, go the Google Play Store, then tap Menu > My apps & games. Tap UPDATE next to Ayoba! Free Quick Messaging.
Another way, go the Play Store then search for Ayoba. Tap UPDATE under Ayoba! Free Quick Messaging.
On the Ayoba website
You fit update your Ayoba app on our website, just visit Ayoba.me/download
How I go take install Ayoba again?
If you wan install the Ayoba app again, you go first delete am from your phone. Before you do am, we go advise say make you backup your chats. Just tap the button where dem write menu, then select Settings, then tap on Maintenance and select Chat Backup.
This one go safely backup your chats go the Cloud, and allow you return your chat from before before if you need am. Know say your backups dem no dey inside your handset oh, so you go need to get internet if you wan do backup.
Abeg follow these steps dem if you wan delete Ayoba and install am again:
Option 1:
- Touch and hold the Ayoba sign for the Main Screen until the sign start to dey shake
- Press the X wey dey the corner of the Ayoba sign
- Tap Delete so you go remove the application and all the information wey follow am
- Press the Main button
- Download Ayoba from the Google Play Store again.
- To return your Chat Backup, you go tap the menu button, then select Settings, then tap on Maintenance and then select Chat Backup, e go return.
- You fit also visit the Ayoba website go download the app and install am again at any time. If you be MTN user you go fit download Ayoba for free*, you no go use your data.
*During the promo period
Option 2:
- Touch and hold the Ayoba sign for the Main Screen and then drag am drop am inside the dustbin/Uninstall bin
- Select uninstall to confam say na delete to remove the application and all im information
- Press the Main buttoon
- Download Ayoba again from the Google Play Store.
- To bring back your chat from where you store am, you go tap the menu button, then select Settings, then tap on Maintenance then select Chat Backup, and restore.
- You fit also visit the Ayoba website go download the app and install am again at any time. If you be MTN user you go fit download Ayoba for free*, without using your data.
*During the promo period
Confamation
How I go take confam my number?
Once you download the app. open am then follow the steps:
- Put your full name
- Choose your country from the list wey go drop-down. This one go automatically put your country code for your phone number
- Put your phone number inside the box under
- Tap verify to ask for code
- Entre the 6-number code wey you get by text message
I no get the 6-number code by text message
- Wait for the time to count finish then select Send text message again.
- No reason the code o, if not you no go fit entet your account for some time. This one na security wey go make sure say anoda person no go fit see road enter your account.
If the probelm still dey, abeg try this one dem:
- Reboot your phone (To reboot your phone, off am, count 30 seconds, then on am again).
- Delete this Ayoba then install the latest model of Ayoba.
I fit use Ayoba on top two handset?
You fit confam your Ayoba account with only one number for one handset. If you get double SIM phone, abeg know say you must still choose one number to confam with Ayoba. E no get way to operate Ayoba account with two phone number.
I go need register again if I remove the app then install am again?
No you no need to. All you need do na to download Ayoba from the Google Play Store again or from Ayoba.me/download. Enter your name, select your country from the drop-down menu, enter your phone number then select verify.
Know say: If you don back up your chat history before you delete the app then install am again, your chat dem from before go come back automatically.